9/17/11

ZODIAC KOLO

As i sidon begin dey write this note, I just dey think how this thing don affect people. Zodiac matter no be small thing o. E dey burst some people head and some people sef dey combust on top this matter. Make my people no vex o, sey I dey write this ogboge note for pidgin. I sabi sey no be my usual style but my body just dey totori me make I nak am for this particular languagze. My friend, if you think sey e easy to just sidon dey begin dey rap for broken, na lie. De way I dey think am sef, I no no, but my hand just dey do ‘patura patura’ (dat wan na new grammar wey I just form naw naw). I no no de meaning o. I no sey u people no sey I kolo for normal African day but dis wan don pass kolo, e don be like sey crayfish dey commot play ten ten for my head (but dears, I’m loving this *smiling all the way*). As I be don dey talk before, e be like sey dis zodiac matter don scatter ground o. Shio, e no easy again, everybody don begin dey post dem sign on top all waka throw-way network wey don full ground for dis our world o. Wetin I dey yarn be sey if pesin no address dis issue, e go erupt like volcano. I no go lie for dis matter o, I don do watch dog well well sotay my nose sef don turn sniffing machine; and my tori get good ground because I arrangze am well. If I wan follow de order wey be dey dey, I go say na Aries first pass all of dem sign but I no dey do am like dat, I go enter am push Aquarius for ground first. Una see dis AQUARIUS (Jan 21 – Feb 19) people so, na oversabi dem be, dem like to dey no every tin wey sele. Na amebo work dem born dem do, dem con spoil am join sey dey no dey get feeling for pesin. If una think sey Aquarius go show una sympathy abi wetin dem dey call am in English, u don jonz be dat. Der emotion level no dey pass zero so make una shift fast fast go sympathetic another place. De correct tin about dem be sey, dey no judge anybody, so if una dey find correct friend, wey no dey judge, na de Aquarius be ya biggest bet. As for dis next groupie... chai... dey too dey dream, dem suppose be Joseph the Second 'alala'. Una see dis people ehn, dem dey call dem PISCES (Feb 20 - Mar 20) , even de name hard to pronounce sef... dem too dey like to dey waka dugbe, de wan wey Oyinbo people dey call 'Adventurer', na to say der life no stable at all, at all. But dem sabi, kai! no dey joke wiv dem o, dem too know, if dem say na wetin go sele de next minute, make una believe dem o, nitori not to believe, na wahala be dat o. dey no dey like reality sha, I get one friend like dat wey im belong to dis group, e go tell me sey na de most realistic person im be, but na lie, e no rea - anything... dey too dey touchy touchy, u no fit offend dem, kasala go burst. anyway, me I think sey dem dey okay sha but dey should try dey mellow small small o. Dem be too dey like attention, der second name be 'Attention seekers'. Der name na ARIES (Mar 21 - Apr 20). hmmm, dis people no get sense, sorry o, but na truth I talk, dem no dey think before dey go open deir big gorodom which dem call mouth dey begin dey yarn anyhow. dem sabi lead sha, e be like sey, de day deir mama born dem, dey begin to dey direct people, dat one sef dey n im be good tin but forget dat one o, dey no dey sure of demselves, dem be no.1 doubting thomas, Thomas sef try pass dem. Dis TAURUS (Apr 20 - May 20) people no dey hear word at all, dem stubborn; dem be like goat wey be sey if una beat dem, dey go still come back con find wahala. no be only dat o, dem lazy too ehn... kai! I no see any pesin wey lazy pass dis group, deir laziness na first grade, dem no dey like change again. I tire for dis people o, if no be sey I get dem plenti for my house, I for sey I no wan get anytin to do wit dis people, deir own too much. but dem soft sha, hei... Chimo! I no see any wan wey dey patient and generous like dis people, My heart just dey do jolly jolly as I dey think am. Na everyone get deir bad side sha. Na my people be dis, so no vex, I go dey bias small, as you see us so dey bin dey call us GEMINI (May 21 - June 21). we too dey judge pesin, before we even no dem sef, we don already dissect dem, well, no be our fault sha, na like dat we bin dey. we too sabi small gbeborun but una know dat na for better life na. we no dey show our true feelings o, so make dem no use us play ball, we dey shield our body die... kai. we bin get natural odeshi for body, noboby fit do us anyhow but we dey think well well sha. Our brain dey kampe. CANCER (June 22 - July 22) as dem call dem so, na so dem be. Dem be real cancer, dey no get emotion for body, dem be like stone wey u go try squeeze water out of am but u no fit. U no fit predict dem, dey fit be superman one minute change to wolverine de next, dem be no.1 chameleon; and dem be like plastic,dem too dey fragile but dem dey trust people sha, and dey sabi hold sometin for mind for very very long time. Na LEO (July 23 - August 21) be ma next target, dem no dey get side for anybody mata, but dem too dey pretend...Ngwanu?, dem be like tortoise wey dey hide inside im shell make nobody see im true colour. Dey no too get money sense too, dem dey spend anyhow. Deir head com swell like ball wey no refuse to burst because of pride wey dem get inside dem. But dem good o, sey dey no dey get anybody for mind, if una offend dem just no sey dem go forgive you true true. Dis kind people no too dey think, dey no even get wetin dey wan do for mind. Deir name na VIRGO (Aug 22 - Sept 23), u see dis people ehn, dey too dey like arrangze deir mind and dey sabi worry, Chai, even poor pesin wey get problem no fit match deir kin worry. Blessed are the peacemakers, Amem! dey sabi settle quarrel, in short dey fit turn am to hobby, dey no like fight at all, and dem will solve problem pass pesin pastor sef. Na real party people be dis next set, dey like de high life, if deir nose smell owambe 50feet away, dem go dey der. Dey call dem LIBRA (Sept 24 - Oct 23). As deir name be, na so dem be, Libra be like wen u talk sey pesin free, dey bin want make everybody like dem, and na dem like demself pass but dey sabi put ear for sometin pesin dey talk, and dey sabi show concern sef. Dey get sense well well but dey no dey like to show am, and deir life dey peaceful boku. Jealousy jealousy na im dey worry the next group, their name be like scorpion, una wan hear am,na SCORPIO (Oct 24 - Nov 22). Dey sabi do cunny cunny, and dem too dey like to dey control people and dem sabi keep secret like dat badger whisperer animal wey dey hide and no wan make any body see am. dem too dey emotional and dey sabi suspect pesin too much. but sha o, dem go sabi do student well union cos na dem dey loyal pass. Waka dugbe for everywhere, dey too sabi waka around the world, dem be dey call dem SAGITTARIUS (Nov 23 - Dec 22). dey no like commitment, no fit stay with one pesin for long, dey like to dey jump up and down, na busy body dem be. Dey dem work better wen pressure dey on top deir head sha and dem dey independent plenty. Last last na de CAPRICORN (Dec 23 - Jan 20) be dis o. Dem dey get discipline well well like military, dem too dey structuralized everytin, and dem be like watch dog wey dey check everytin wey dey happen for everywhere. But dem like to dey command pesin too much sha, dat one sef no dey okay and dey no dey think somethin at all. As I write all dis kin pesin full for here, I hope sey you people no dey vex for me as I don analyse una so. Abeg no vex o, no be me talk am, na so e bin dey.

1 comment:

  1. hahahahaha
    so cool! i wish i could speak and write in pidgin
    but i can't :(
    you should write another piece

    ReplyDelete